WAEC Maths expo: WAEC reveal how 2021 WASSCE General Mathematics, English papers leak

 Schools

WAEC Maths expo: WAEC reveal how 2021 WASSCE General Mathematics, English papers leak




Students dey write WAEC paper for Ghana

West Africa Examination Council [WAEC] don threaten to take action against schools wey get hand for examination malpractice across Ghana.

WAEC say dem discover General Mathematics and English Language papers leak on social media.

"Cheating" social media groups be dey in full swing prior to de conduct of de Mathematics (Elective) and English Language Papers on 9th and 13th September, 2021 respectively." WAEC confam am for statement.

De council give names of 11 schools wey allegedly involve for some of de examination malpractices, say dem dey on dia watch list.

Dem also mention de names of di alleged 'rogue' websites wey circulate several versions of de questions on social media.

Although WAEC say reports from dia investigation and further information demma receive show say de circulation no be too dey extensive.

But de next line of action be to punish alias sanction all de pipo wey dem find culpable [those wey dey involved].

No comments:

Post a Comment

Featured Post

What to know about relationships

  Nigerianewslite   Italian Relationship: 1st day= Sex 2nd day= Sex again. French Relationship: 1st day = movies & kiss 2nd day = Sex 3r...